Nigerian senators salary: Authorities give breakdown of take-home pay - BBC News Pidgin (2024)

Nigerian senators salary: Authorities give breakdown of take-home pay - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Nigerian Senate/Facebook

Di Revenue Mobilisation Allocation and Fiscal Commission (RMAFC) don tok say each senator for Nigeria dey earn 1,063,860 naira monthly.

MB Shehu wey be chairman of di Commission yarn dis one for one statement wey di Federal Ministry of Information publish on dia website.

E say dis clarification dey important sake of di recent statement by former lawmaker "Shehu Sani wey dey reported to disclose say Senator collect monthly running cost of 13.5 naira in addition to di monthly 750, 000.00 naira prescribed by di Commission".

Di RMAFC oga say di Commission no get di constitutional powers to enforce compliance wit proper implementation of di Remuneration package. E say dem di National Assembly dey address dis.

  • Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve
  • End bad government protest show anger and hunger for Nigeria

Breakdown of wetin Nigerian senators dey earn

According to RMAFC, monthly salary of senators na 1,063,860 naira.

  • Basic Salary - 168,866:70 naira;
  • Motor Vehicle Fuelling and Maintenance Allowance 126,650:00 naira;
  • Personal Assistant 42,216:66 naira;
  • Domestic Staff -126,650:00 naira;
  • Utilities -50,660:00 naira;
  • Newspapers/Periodicals - 25,330:00 naira;
  • Wardrobe - 42,216,66:00 naira;
  • House Maintenance - 8,443.33:00 naira;
  • Constituency Allowance - 422,166:66 naira.

Bello tok say some allowances dey regular while odas no dey regular.

E senators dey receive regular allowances regularly wit basic salary while non-regular allowances na as at wen due.

"For instance, furniture allowance (6,079,200 naira) and severance gratuity (6,079,200 naira) na once in evri tenure and vehicle allowance (8,105,600 naira) wey dey optional na loan wey di beneficiary gatz pay bifor leaving office."

Bello say wit di exception of some political, public office holders like di President, Vice President, Senate President, Speaker of di House of Representative etc, all Public and Legislative Officers no longer dey get housing allowance, wey be di norms for di past.

I dey get 22 million naira evri month - Sen. Kawu

Nigerian senators salary: Authorities give breakdown of take-home pay - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, Sen. Kawu Sumaila/Facebook

Meanwhile, di senator wey dey represent Kano South senatorial district for Kano State, Kawu Sumaila, tell BBC Hausa for interview say im dey receive about 22 naira million evri month.

E however clarify say na only less dan one million naira from dat moni be im salary.

"Wetin I dey receive as salary per month dey less dan one million naira afta di deductions. E go be around 600,000 naira or a little more," di senator tok.

But aside from salaries, Oga Kawu tok say "evri senator dey also receive 21 million naira as moni to take dey run dia office evri month", and e add say na recently di moni increase reach dat amount.

"I no know of any oda moni wey any senator dey collect," e tok.

Nigerian Senate react to Obasanjo statement

Nigerian senators salary: Authorities give breakdown of take-home pay - BBC News Pidgin (3)

Wia dis foto come from, Nigerian Senate/Facebook

“Na Revenue Mobilization Fiscal Allocation dey pay our salary, and e dey in strict accordance wit constitutional provision.”

Dis na how di Nigerian Senate take react to former Nigerian President Olusegun Obasanjo wey say e dey immoral for members of di National Assembly to determine dia own salaries and allowances, according to reports.

For one statement wey di Senate tok-tok pesin Yemi Adaramodu issue on Sunday, 11 August on im X account, e say di claims by Oga Olusegun na attempt to crucify di legislature.

Dem say no senator don receive any financial patronage from di presidency.

“To set di record straight, di Senate stress am say dem dey only collect di salary wey di Revenue Mobilization Fiscal Allocation Commission allocate, in strict accordance wit constitutional provisions.”

But e no tok di exact amount RMAFC dey pay dem as salary .

Oga Adaramodu clear am say “di constituency projects wey dey linked to legislature na small thing wey senators dey suggest and nominate, following practices wey dey common for oda democracies worldwide.”

Skip Twitter post

Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post

Wetin former president Olusegun Obasanjo tok

Nigerian senators salary: Authorities give breakdown of take-home pay - BBC News Pidgin (4)

Wia dis foto come from, Getty Images

According to plenty local media reports, di former Nigerian president Olusegun Obasanjo bin host some members of di House of Representatives for Abeokuta, di capital of Ogun state, south-west Nigeria and dem tok many tins wey include di current situation for di kontri, di bill on one single six-year term and rotation between di North, among odas.

For di meeting, e accuse lawmakers say na dem dey decide dia salary and allowance, as e claim say na di duty of di Revenue Mobilisation Allocation and Fiscal Commission (RMAFC) to determine wetin public officeholders suppose earn and lawmakers no suppose fix dia won salaries and allowances.

“You no suppose to fix your salaries or your allowances; na di RMAFC suppose do am, but you decide what you pay yourselves, di allowances you give yourselves — newspaper allowances, pant allowances — you give yourself all sorts of things. Wit due respect, you know say e no dey right.

“E no dey right for me to be di one to declare and determine wetin I go pay myself. E dey immoral, and then you dey do am.”

“Di senate dey do am, and for some cases, di executive dey give una wetin una no dey entitled to. All of una get N200 million.” Obasanjo tell dem.

Dis no be di first time wey di former presido go express dis concern and make dis claim.

For 2023, during one public lecture wey dey part of di activities wey dey organised to mark di 60th anniversary of di Call to Bar of legal luminary Afe Babalola (SAN), e tok di same thing.

Reports say then, Oga Obasanjo bin lament say most of di pipo wey suppose uphold di Nigerian Constitution na di ones wey dey abuse di kontri democracy pass.

E bin give example of constitutional abuse, wia e say na situation wia members of di National Assembly fix dia own salaries wey dey in clear violation of di duty of di Revenue Mobilisation and Fiscal Commission.

For im remark, Obasanjo bin say “By di Nigerian Constitution, na di Revenue Mobilisation and Fiscal Commission suppose fix di salaries and emoluments of di members of di National Assembly, but dey (lawmakers) set di constitution aside and dem decide to fix dia salaries,”

Di senate bin explain further say as di executive arm of goment, dem through dia various ministries dey responsible for awarding contracts for constituency projects.

Dem add say di funds wey dey allocated for these project vary, depending on di number of constituencies for each state and di intention to ensure say every region of Nigeria benefit from federal resources.

Nigerian senators salary: Authorities give breakdown of take-home pay - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Starbucks Corp (BMV:SBUX)
8-13 Pod - Which fork in the road will you take? Inflation numbers came in great - good news is good news - market popped
Terraria Enchanting
Gabrielle Abbate Obituary
Irving Hac
What Happened To Father Anthony Mary Ewtn
Geometry Escape Challenge A Answer Key
Our Facility
Keurig Refillable Pods Walmart
Craigslist Farm And Garden Cincinnati Ohio
Google Feud Unblocked 6969
Mail.zsthost Change Password
Beebe Portal Athena
Roof Top Snipers Unblocked
Csi Tv Series Wiki
Sadie Proposal Ideas
What Is Vioc On Credit Card Statement
Rufus Benton "Bent" Moulds Jr. Obituary 2024 - Webb & Stephens Funeral Homes
[PDF] NAVY RESERVE PERSONNEL MANUAL - Free Download PDF
Aliciabibs
How To Tighten Lug Nuts Properly (Torque Specs) | TireGrades
Apparent assassination attempt | Suspect never had Trump in sight, did not get off shot: Officials
Ltg Speech Copy Paste
480-467-2273
Is Poke Healthy? Benefits, Risks, and Tips
Tamil Movies - Ogomovies
Yu-Gi-Oh Card Database
Our Leadership
Gncc Live Timing And Scoring
Parent Management Training (PMT) Worksheet | HappierTHERAPY
Mercedes W204 Belt Diagram
Lowell Car Accident Lawyer Kiley Law Group
Log in or sign up to view
Toonily The Carry
The Syracuse Journal-Democrat from Syracuse, Nebraska
Today's Gas Price At Buc-Ee's
Mohave County Jobs Craigslist
Wal-Mart 2516 Directory
Bernie Platt, former Cherry Hill mayor and funeral home magnate, has died at 90
Wo ein Pfand ist, ist auch Einweg
Armageddon Time Showtimes Near Cmx Daytona 12
Umd Men's Basketball Duluth
Todd Gutner Salary
Thotsbook Com
Garland County Mugshots Today
Catchvideo Chrome Extension
Barback Salary in 2024: Comprehensive Guide | OysterLink
Parks And Rec Fantasy Football Names
Lake County Fl Trash Pickup Schedule
Invitation Quinceanera Espanol
Coors Field Seats In The Shade
Latest Posts
Article information

Author: Carmelo Roob

Last Updated:

Views: 6232

Rating: 4.4 / 5 (45 voted)

Reviews: 92% of readers found this page helpful

Author information

Name: Carmelo Roob

Birthday: 1995-01-09

Address: Apt. 915 481 Sipes Cliff, New Gonzalobury, CO 80176

Phone: +6773780339780

Job: Sales Executive

Hobby: Gaming, Jogging, Rugby, Video gaming, Handball, Ice skating, Web surfing

Introduction: My name is Carmelo Roob, I am a modern, handsome, delightful, comfortable, attractive, vast, good person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.